Revenue

Revenue

Chitika ads

Revenue

chitika ads

Revenue

Revenue

Revenue

Revenue

Wednesday 13 April 2016

Fulani herdsmen don kill 45 people again for Taraba, kilode?


 We don hear am again o! Them don kill at least 45 people and them still come displace over 100 people for Taraba state. The senior special assistant to Taraba state Governor on media and publicity, Sylvanus Giwa confirm am for one statement say 20 people na him them kill for Angai Village, 9 for Maisuma and Dorei Villages, as if say na good thing, them  come top am with 7 more at Fali village.
   For the statement, the fulani herdsmen carry attack enter the community because say the villagers no gree make them rape one lady. 

Na wa o, see as this man beat him wife because say she proud


   Na One User for instagram share the picshaw wey one woman, wey be her hairstylist get injuries for face and for neck, talk say na her husband beat her so o. When them ask her say wetin make her husband do her like that, she talk say her husband dey accuse her say she dey proud because she get successful business. The woman say no be the first time wey this kind thing dey happen be this o. see wetin she type below.

Tuesday 12 April 2016

Snoop Dogg Para give Arnold Schwarzenegger


   Rapper, Snoop Dogg, carry para enter IG go blast ex california governor, Arnold Schwarzenegger, after them release pikin of a California state Assembly speaker comot prison after him serve just six years of a 16-year prison sentence for manslaughter. Him sentence dey drastically reduced by Arnold for him last day in office as governor of California back in 2011.
   Snoop Dogg come bark and bite Schwarzenegger for the kind favoritism wey him show to him political friends and him come ignore notorious reformed gang banger Stanley 'Tookie' Williams.

Smh!

Lmao!

Stella Damasus' “The Alternative” dey Drop on Her Birthday


  Stella Damasus wey be actress before before, wey don turn gospel singer now but still dey take style act, don yarn us the release date of her new album, ‘The Alternative’ for Instagram and her official website. The album go drop on iTunes and Google Play on the 24th of April which be her birthday, and my own birthday!.

Buhari Don talk say Nigeria suppose dey Export More go China


 President Muhammadu Buhari don tell Nigerian and Chinese business communities say make them work harder to reduce between the two countries because say, trading dey currently in China’s favour. One statement wey them issue for Abuja by Femi Adesina, wey be the Special Adviser on Media and Publicity to the President, said Buhari made the call while speaking at a Nigeria-China Business/Investment Forum in Beijing, China, on Tuesday.

President Buhari talk say trade and economic relations between the two countries gats dey mutually beneficial and conducted with respect and trust. Na so nau. 

Read this Press statement wey concern kidnap of Channels TV reporter for Imo state


Read the statement from NUJ below...

Nigeria Union of Journalists (NUJ) Zone C (South East) has received with shock, the report of the kidnap of Channels Television Correspondent in Owerri, Imo State, Mr. Tope Kuteye by 3am Monday April 11, 2016. Kuteye was reportedly kidnapped at his residence in Owerri.
We condemn the kidnap of this innocent citizen and journalist. Kuteye is neither a politician nor a money-bag business man. It therefore baffles the Union as to why he should be the target of this dastardly act.

see wetin Ministry of Budget and National Planning put for statement


  Una never see? Oya, make una take style read the statement wey Akpandem James release to the Minister of Budget and National Planning, Udoma Udo Udoma below. 

In view of the recent controversies surrounding the 2016 budget, it has become necessary to state the following so as to set the facts straight:
The details of the 2016 budget were received by the President on Thursday, April 7, 2016.
Immediately this was received the President, desirous of signing the document into law as soon as possible, directed that copies should be made available to Heads of the various Ministries, Departments and Agencies (MDAs) of the Federal Government.

France Football magazine don list Mr Alex Iwobi among Africa's top five players in Europe


One kind big football magazine wey them dey call France Football don name Ogbeni Alex Iwobi among the top five best African players in Europe in the last one week. The 19 year old, wey be Naija international, don dey shine pass firefly for Arsenal after Brother Arsene Wenger.

Saturday 19 March 2016

Ooni of Ife and his new wife visit Sultan of Sokoto


The Ooni of Ife, Oba Adeyeye Enitan Babatunde Ogunwusi, Ojaja II and him new wife Olori Wuraola don pay visit to the Sultan of Sokoto for him palace wey dey Sokoto yesterday. More pictures dey below. 

“Jude was only a scape goat and a victim… the truth is Peter and Paul have issues!” – Paul Okoye Talk am


  Paul Okoye of the separated duo, P'square don speak out to clear the matter wey dey ground so. Him say even if Jude do retire say him no be manager again for over one month, the kasala wey people been think say na Jude dey cause still dey ground o! Him message carry plenty emotion, even me wey read am dey moved. Na the message dey here so:
‘All you all want is psquare,…all I want is family, love and care! Social media is the new root of all evil! There’s family before Psquare and there will always be family after PSquare ….Jude was only a scape goat and a victim. The person who  has been keeping us together for all these years,..the truth is peter and Paul have issues!. For the first time I decided to do something outside Psquare ,and that is the case study here. I have always supported my brother 100% from His personal endorsements to dance with Peter which some re still on my I.g… Now I have just 3 questions….

See wetin Ibinabo Fiberesima Talk for vanguard interview


  For one interview with Ibinabo Fiberesima wey Vanguard Newspaper’s Benjamin Njoku do, him question her well well about her stay for kirikiri prison.
According to wetin the writer write, in 2009 a them release Ibinabo Fiberesima comot prison, she talk say
 “I have learnt how not to trust anybody any more. I put my trust now in the Lord. And this is better explained in the new song I recorded. The music captures my story. Emotionally, I have been drained and to some extent humiliated, even in public…I wasn’t happy that I was involved in that accident. I have said it over and over again that I’m deeply sorry that it ever happened. I don’t know how else to atone for the accident. I started begging my victim’s family from the very day the accident happened. My family attended the funeral rites and service of songs and I even attended the 40 days prayer when I was strong enough to move about. I met with the mother and the wife of the deceased. There’s virtually nothing I didn’t do to plead with the family of the deceased to let me off the hook. I’m still pleading with them as I speak with you right now.”

Lagos don jail those men wey them accuse for kidnapping those 3 school girls..Justice!

  Na on friday wey the Ebute Meta Chief Magistrates' court remand 6 men wey them accuse say them kidnap 3 girls from Babington Macaulay Junior Seminary College for ikorodu, Lagos. Na Chief Magistrate, O.I.Adelaja talk say the accused go remain for ikoyi prisons till the advice of the Director of Public Prosecutions go show. She come adjourn the case go April 25. The 6 men wey them carry go court na Emmanuel Arigidi, 37; Gift Pius, 30; Fred Omoni, 32; Geofrey Owei, 28; Seun Akanji, 33; and Segun James, 29, them dey face 5-count charge wey be conspiracy, kidnap, armed with offensive weapons and robbery.

C. Ronaldo plus him teammates totori one 5 year old pikin belle


  Cristiano Dos Santos Ronaldo,yes, na him full name i call so, along with part of him teammates them visit one 5 year old pikin wey no get papa or mama from Palestine. I gather say the pikin (Ahmed Dawabshah na him real name) papa and mama been die from one bomb attack for Palestine wey shele like 8 months ago, so sad. Ahmed don dey try fight for him life since that bomb attack don happen, by the time this small pikin go wake up, the fir question wey him ask na 'where is my mother?'. The matter come touch madrid after them learn say C. Ronaldo na this small pikin idol, them kukuma plan Trip for Ahmed say make him travel come Santiago Bernabeu stadium, wey be Real Madrid own, make he come meet him idol! 

Friday 18 March 2016

Truck wey dey carry police go Rivers state for rerun election don get accident, na wa o!


    Some policemen wey dem carry for Akure wey be the capital of Ondo state , go Rivers state for the election wey them wan rerun don get accident along Akala-Olu community for Rivers state. The registration number for the truck na "NPF 5205 C", the truck jam another truck wey dey transport cows. E go reach like five cows wey die for the accident and plenty policemen still carry injury, see images below. 

Timi Dakolo don get him master's certificate, Twale o!


  Timi Dakolo, that bros wey been win Idols West Africa, carry head enter one songwriting program wey dem dey do for Berklee Online extension school by berklee college of music and congratulations, him don finish the program. Him write say
'I can't describe the feeling...words would be inadequate. .. Just grateful to God...and Family... All of the things I have Accomplished ...My Grannie would really be proud of this one!!!'

Even One Million Officers of the DSS cannot Intimidate Me – Na Gov. Fayose talk am o


   For on kind statement wey the special assistant to the governor on Public Communications and New Media, Lere Olayinka, Governor Ayo Fayose don talk say: 
   “If Buhari likes, let him relocate all DSS men in Nigeria with the entire ammunitions in their armoury to Ekiti, the will of Ekiti people can never be broken. They will only try, and like they have always done, they will fail because dictatorship has never triumphed over the people. Even Buhari’s dictatorship between 1984 and 1985 ended one day and Nigerians will also outlive his present dictatorship.”
  For another statement wey the secretary to the State Government of Ekiti state, Modupe Alade, Governor Fayose don let us know say President Buhari no fit intimidate am o, laye o!

“I stopped being Psquare’s manager over a month ago’ – Jude Okoye


      Jude Okoye,  the elder brother of the taye and kehinde, Paul and Peter Okoye of Psquare who been dey occupy two positions for their lives (the elder brother and manager) don tweet am say him no dey manage the tw of them again o. You suppose remember say Peter, few weeks ago, talk say Jude no wan step down as them manager o, the thing come cause gobe between the brothers o. Jude don dey manage him  brothers for ten years but him don retire now.

police don release that young man wey them arrest because say him marry one babe without Her papa and mama go ahead


  Their names na Nono and Ugo Madugba, na since yesterday them don dey trend so. Na for yesterday Nono Orji post am for facebook say her papa and mama don arrest her husband o, wetin happen? she come say them arrest her because she go marry Ugo without their go ahead, na so life be? She come appeal to we Nigerians say she dey fear say police fit poison her husband. See wetin she post for facebook:

Lekki gardens don vow say them go offer full support to people wey survive the building collapse


    Lekki Gardens & Homes, the real estate company don yarn say them don get lans to take care of wetin the families of the victims of that building collapse go need o. na the time wey them visit the survivors forthe General hospital. the development and welfare team wey represent lekki gardens talk say the company go dey kampe till the last victim go comot the hospital go meet him family o, na good idea. Them still come promise say them go still support every family as them dey wait make Lagos State government conclude "the process and compilation of statutory autopsy report that would determine identification of the deceased and expedite engagements with the bereaved."

Families of victims wey Die for that Ojuelegba 2015 tanker crash don sue lagos State Government for N10 billion


   The families of the 3 victims wey been die for the tanker wey fall comot bridge for Ojuelegba, Lagos don sue Lagos state government for Federal high court wey dey Lagos. Them dey sue Lagos state government say the respondents (na them be commisioner for justice, Lagos State Metropolitan Area Transport Authority, the Lagos Public Works Corporation, Motor Vehicle Administration Agency, the Federal Government, the Attorney General of the Federation ati beh beh lo).
 dey 'negligent', as in, them neglect them,. Na Norrison Quakers (SAN) represent the families of those victims.

Tuesday 15 March 2016

Senator Bukola Saraki don talk am say them go reintroduce Gender and equal opportunity bill!


The 8th time wey senate go reject the Gender and Equality bill cause plenty kasala for Naija as them reason am say the lawamakers wey reject am dey insensitive to wetin Nigerian women dey go through.
E no even tey at all wey Senate president, Bukola Saraki dey respond to a tweet talk say the bill go return. 
Senator Bukola Saraki still come post for him Facebook page say:

Swiss Government Talk say them don return $732 wey Abacha loot in the last 10 years


 The people wey dey govern ,abi na rule, switzerland don reveal am say them return  $723 million (na like N142.43 billion) wey Abacha loot to we country government for this last 10 years o! Na Premium times been report that one, The agreement wey them call  “Letter of Intent on the restitution of illegally-acquired assets forfeited in Switzerland,” dey signed by Nigeria’s Attorney-General and Minister of Justice, Abubakar Malami, and the Swiss Head of Foreign Affairs Department, Didier Burkhalter. 

Equatorial Guinea don give We President Buhari With national Honour Wey high pass!


We learn say them give our very own President Buhari the highest national honour for the Republic of Equatorial Guinea. Na the president for there, President Teodoro Obiang Nguema Mbasogo give am this honour! Them say the name of the honour na Grand Collar of the Order of the Independence. As them give am finish, them come treat Buhari to a state banquet!

JAMB don say make una wey dey protest Calm down o!


    Some Jambites don plan to protest unto say them believe say some kind challenges dey the conduct of the UTME wey dey go on. That protest don dey cause unease for the examination body o.

The Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB) in this vein don issue warning to those candidates wey wan burst kasala say make them no allow anybody use them for selfish gain o. Them come issue a statement last night, in Abuja by the head of media of JAMB, Dr Fabian Benjamin, wey him title be:  “Protest By Education Consultants,” . The statement been tell candidates say make them dey avail themselves of the chance wey the board provide through him public complaints unit , say make them use am vent their grievances
The board say e done :

Lekki Gardens don release statement concerning building collapse



    Lekki Gardens don put out statement unto that building wey been collapse along Lekki-epe expressway. na the statement you go see after this one: 
On the 8th of March 2016, a sad tragedy befell our organization, the Lekki Community, Lagos State and The Federal Republic of Nigeria which led to unfortunate deaths. Due to the prompt response of the Lagos State Emergency Authority (LASEMA), the Lagos State Fire Service, Lagos State Ambulance Service (LASAMBUS), Red Cross, National Emergency Agency (NEMA), Lagos State Building Control Agency and the Rapid Response Squad (RRS), Thirteen (13) people survived the disaster.

To this end, we are committed to making sure that this kind of tragedy does not fall upon anyone within and outside our project areas.

UN Security Council Don Say Them No Like The Ivory Coast Terror Attack wey kill 18 People

  
     United Nations Security Council don condemn the kind attacks wey happen for ivory coast for the weekend, na a total of 18 people of which 15 of them na civilians, what a pity! The council put am for statement today, say them wan bring justice on the attackers and the organizers. Al-Qaida don claim responsibility for this attack since the thing happen. 
  Na for Grand Bassam, one famous beach resort wey dey Ivory coast turn site of slaughter as six armed men carry guns enter beach, come dey shoot anybody wey dem see, na make God dey help us remain. 

Freeze wey be OAP, AY Makun wey be Comedian & More Celebrities don react to How them take arrest Lekki Gardens Boss O!


 Una Remember say on one tuesday like this, one Five story building wey dey under construction along Lekki-Epe expressway collapse, na him kill 34 people! As them come ask say na who get am, na him them gather say na Lekki Gardens own am and the MD, Richard Nyong come report himself to the office of the commissioner of police. Him do right thing bah? Wetin come dey shock we country people come be say the come put chain, abi na handcuff for the Md and him  contractor hand as them dey carry them go court for the commencement of trial!
  Na this one come begin make some celebrities dey para o! them say the no gbadun as them take arrest the 34 year old real estate mogul! na wa o.
  Anyway, as the thing dey shele sha, OAP, freeze don express him own opinion in writing, him say :